Sunday 12 November 2023

Bayelsa state govnorship election result live update

Inec don begin dey call di results for Bayelsa state governorship election local government by local government.

Bayelsa state pipo go to di polls on Saturday for Nigeria to vote who go lead dem for di next four years.

Bayelsa State Returning Officer Prof Farouk Kuta, Vice Chancellor of Federal University of Technology, Minna begin announce result around 10:00am on Sunday.

Before di collation bin commence, BBC Pidgin monitor situation outside di state collation center wia supporters of di PDP carry protest come INEC headquarters for Yenagoa to protest say some alleged supporters of APC no allow dem participate for di elections for Nembe- Bassambiri.

Security no too allow dem go near di collation center.

Di State Govnor, Sen Douye Diri of di Peoples Democratic Party, PDP, dey seek re-election and go face oda candidates including Timipre Sylva of di All Progressives Congress, APC, and Udengs Eradiri of Labour Party, LP wey be youth leader from di state.

Na di Independent National Electoral Commission, INEC, go declare who win.

For govnorship election, di candidate wit di highest number of cast votes na im dem go declare winner – na di Returning officer of Inec go make di declaration.

According to di Electoral Act, di candidate must also get more dan one-quarter of di votes cast in at least two-third of each local goment area of di state.

0 Comments:

Post a Comment

Subscribe Us